Friday, August 28, 2015

Jokes for the weekend

Dem say Boko Haram don poison beans after I buy half bag for house. From the one wey I cook, I give my dog, Bingo, make im first test am. 45mins later, bingo still dey waka, dey jolly. Na im I come chop my own. After I don chop finish, my gateman run come tel me say bingo don die, hey!
I run enter house, begin drink full gallon of palm
oil for my belle, chop 22 bitter kola wit 3 long bitter
leaf stem, chop walnuts with the shell no time to
crack, swallow moringa with aloe vera as treatment
combo. Garlic and onions be like sweet for my mouth. I come dey sweat as if na oven be my bedroom.
I dey think say my life don finish.
I come outside. Na im gate man come they tell me say the driver wey kill bingo wan come beg me!
If na u, wetin u go do the gate man? Don't laugh alone. Good morning

No comments:

Post a Comment

Note: Only a member of this blog may post a comment.